*ENG:-* As it is written in the Bible.
*WARRI:-* As them yan for Bible.
*ENG:-* Jesus entered the boat with his disciples.
*WARRI:-* Bros J cum enta canoe wit him padi dem.
*ENG:-* As the boat was sailing, there was a great storm.
*WARRI:-* As the canoe dey move, na im yawa cum gas.
*ENG:-* The storm was so great dat it was like a whirlwind.
*WARRI:-* As the yawa dey gas na im kasala burst join.
*ENG:-* The disciples became so afraid that they shouted _Master! Master!!_
*WARRI:-* Na im liver fail him padi dem, na im dey begin dey hala… Bros eh! Bros eh!!
*ENG:-* Jesus got up and calmed down the wind.
*WARRI:-* Na so Bros J get up com arrange the mata.
*ENG:-* he turned to his disciples and said, oh ye with little faith
*WARRI:-* Na im Bros J com look him padi dem shake him head, com provoke say… _“O BOI UNA FALL MY HAND”_
*ENG:-* The disciples replied and said _WHAT MANNER OF MAN IS THIS?_
*WARRI:-* him padi dem com hala “SHOOO…Bros J, which levels naa? U be winsh?” …
Don’t b stingy share it with friends and to any group chat you belong
Shoo this Warri bible make sense o! Hahaha!!